The Unofficial Website for Fela Kuti and Afrobeat Music

Lyrics: ‘97 (Femi Kuti)

The time don come for me to talk
Before I talk make I thank everyone
For the support you na give my family
During our troubles you my friends
Una dey with me
CHORUS: Ninety-seven
I shall never forget
CHORUS: Ninety-seven
The pain, the sorrow, the stress
I want to thank you my friends
I want to thank you my friends

CHORUS:
Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo!
Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo!

Oh yes I remember
The day all of us we gathered
To pay our respect to the one and only Fela
We carry am go him house
Before him spirit go for Eledumare Palace I say

CHORUS:
Together we waka
To carry Fela oh

For those wey no know
Na that day them know
Say the people them love Fela oh 

CHORUS:
Together we waka
To carry Fela oh

From TBS we waka
Reach Ikeja waka
Seven hours waka
Just to carry Fela

CHORUS:
Together we waka
To carry Fela oh

The young and the old
The strong and the weak
The rich and the poor
Them gather to carry Fela

CHORUS:
Together we waka
To carry Fela oh

And then we want start to relax
We no know our problems just start
From no where we hear
Cousin Fran just pas
Just like that she die
We start to wonder why
Enough is enough
The people start to talk
The problems don too much
As  we start to relax
Again and then suddenly we hear
Na the matter of my sister Sola
Come make all of us weak for body
Again we asked ourselves why
For she was too young to die
As we dey cry na so we dey try
We dey struggle to save our life
The doctors themselves them dey lie
Them want to get money to survive
The thing wey dey pain me pass
Na the way she suffer before she died
Na so them dey cut, cut
Dey chook chook
Making experiment with human life

CHORUS: Ninety-seven, ninety-seven, ninety-seven
Oh! My sister Sola oh! Oh! Oh!
CHORUS: Ninety-seven, ninety-seven, ninety-seven

I shall never forget
CHORUS: Ninety-seven
My sister Sola
CHORUS: Ninety-seven

CHORUS:
Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo!
Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! 

Oh yes I remember…