The Unofficial Website for Fela Kuti and Afrobeat Music

Lyrics: Movement of The People Political Statement Number 1 (Fela Kuti and Egypt 80)

Before dem turn us into monkey with tail o
make we hear some important news we e dey o
wey our big government dey hide from us o
we go expose dem o

CHORUS: Gbe won Sita
we go expose dem o

CHORUS: Gbe won Sita
we go expose dem o

CHORUS: Gbe won Sita

We have to talk about the long long time again
we have to talk about it for us to understand
Oba Kosoko dey for Lagos when Englishman arrive
Englishman and Akitoye come drive Kosoko away
U.A.C come JOHN HOLT come others dem come too
eo dey many many many years Africans dem no gree
why you take our land by force dem ask di Englishman?
we have to come to some kind of an arrangement
Englishman no want gree dem start to hire yeye Africans
to fight your brothers and kill dem too
dem give dem guns, uniforms and law
to fight your brothers and kill dem  too, we dey behind your back
we be government be governement be government be government
be government

If you be African man from better family
dem say better family no de join police force
dem say better family no de join soldier force
dem say better family no de galavant around
police for small fight

CHORUS: Small fight
Army for big fight

CHORUS: Big fight
Navy for water fight

CHORUS: Water fight
Airforce for air fight

CHORUS: Air fight

Police college establish too brainwash Africans
army school come start to train di Africans
inside dem school dem start to teach dem nonsense things
di uniform you de wear na him be di authority
authority for you to beat at any time
authority for you to kill at any time
remember na we go de give you di order all the time
di thing wey we dey teach you make e dey your heat all di time
England is di best place, America is di best place too
di black man is inferior to us
you must dey beat dem and kill dem and beat dem and kill dem
na order na order you hear
dise zombies dem start galavanting around
when dem see European you go dey see dem start to shake
wetty dem thick thick boot and dem yeye uniforms
guns for dem hands and dem batons for dem side
vexing and sweating dem walking in di sun by force
vexing and sweating dem walking in di rain by force
di things wey dem dey teach dem e dey ringing in dem head
Englishman is good

CHORUS: is good
Afrika is bad

CHORUS: is bad
English e civilize

CHORUS: civilize
Afrika is bush

CHORUS: is bush

Now let us ask ourselves wetin be government
government na father of the people father must like him son
son must like him father too
but di things wey dey happen for Afrika I will make an EXPLANATION
di government wey we get na overseas sense dem get
dem no be father, we no be dem son
dem be di master, we be di servant
food na plenty money not enough houses to stay
di houses wey e dey dem dey cost plenty money
you go for any town no water for di town
di governent wey we get dem be black man for di face
di government wey we get dem be white man for di YANSH
dat is why you go see o judge dey go

CHORUS: One police go follow am
Assembly man dey go

CHORUS: Two police go follow am
Senator dey go

CHORUS: Three police go follow am
Speaker dey go

CHORUS: Four police go follow am
President dey come

CHORUS: Hundred police go follow am
Thousand police go follow am o

CHORUS: Thousand police go follow am
Riot police go follow am o

CHORUS: Riot police go follow am o
Riot soldier go follow am o

CHORUS: Riot soldier go follow am o
Maja Maja go dey hide someplace o

CHORUS: Maja Maja go dey follow am

N.S.O go dey hide some place

CHORUS: N.S.O. go dey hide some place
C.I.A. go dey hang around

CHORUS: C.I.A. go dey folllow am
Maja Maja go dey stand someplace

CHORUS: Maja Maja go dey follow am
N.S.O go dey hide somewhere

CHORUS: N.S.O. go dey follow am
C.I.A. go dey hand around

CHORUS: C.I.A. go dey follow am
Dem dey

CHORUS: Take chance
Take chance

CHORUS: Take Chance
Dem dey

CHORUS: Take Chance
Take chance

CHORUS: Take Chance

Inside police station dem dey take chance o
inside magistrate court dem dey take chance o
inside High Court o dem dey take chance o
inside Supreme Court dem dey take chance o
(chorus continues...)