The Unofficial Website for Fela Kuti and Afrobeat Music

Lyrics: Many Things (Seun Kuti)

I don hear many things
CHORUS: Many things
I don see many things
CHORUS: Many things
Wey make me think many things
CHORUS: Many things
Wey tire me pass anything
CHORUS: Many things

As time dey go
CHORUS: As time dey go
Things dey spoil more and more
As time dey go
CHORUS: As time dey go
Children dey die more and more
CHORUS: As time dey go
No food to eat
CHORUS: As time dey go
No light to see
CHORUS: As time dey go
No water to drink
CHORUS: As time dey go
Nowhere to stay
CHORUS: As time dey go

I don hear many things
CHORUS: Many things
I don see many things
CHORUS: Many things
Wey make me think many things
CHORUS: Many things
Wey tire me pass anything
CHORUS: Many things

When I see the way my people dey live, under bridge and on top of water
When I see the nonsense things, nonsense things our leaders dey do
When I see the oga of police in prison for stealing
When I hear education minister in scandal for stealing

When I see our senators, throw chair pull agbada
When I see our senators, throwing chairs just to share money
Dem go share the billions, wey dem suppose take feed the people
Dem go share the billions, wey dem suppose take help the people

I don hear many things
CHORUS: Many things
I don see many things
CHORUS: Many things
Wey make me think many things
CHORUS: Many things
Wey tire me pass anything
CHORUS: Many things

When you turn television, and you listen to the radio
When you turn televsion, and you listen to the radio
You go see the things them do, you go hear the things them say
You go see the things them do, you go hear the things them say
You go see the corruption
CHORUS: Lo ri si ri si
You go see the inflation
CHORUS: Lo ri si ri si
You go see the suffering
CHORUS: Lo ri si ri si
Suffering of the people
CHORUS: Lo ri si ri si
Ahh, lo ri si ri si
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, stealing
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, killing
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, shooting
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, movement
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, government
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, party
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, system
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, cheating
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, killing
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, shooting
CHORUS: Lo ri si ri si
Ori si ri si, government
CHORUS: Lo ri si ri si

I don hear many things
CHORUS: Many things
I don see many things
CHORUS: Many things
Wey make me think many things
CHORUS: Many things
Wey tire me pass anything
CHORUS: Many things